aireast.pages.dev


Abdullahi inde dikko biography examples pdf

Abdullahi Dikko Inde, Nigeria Customs Service former boss death touch many Nigerians, as pesin wey bin dem control wetin pipo fit import or export inside di west African kontri for six years. Dikko Inde die at di age of 61 according to di Nigeria Customs Service office wey confam im death. Many local tori report say di former Customs oga die while e dey receive treatment from one hospital for Abuja afta e sick.

Profession: He join di Nigeria Custom Service for Former President Umaru Yar'Adua na im appoint Abdullahi Dikko as Comptroller-General of di Nigeria Custom for and e serve for di capacity until wen e retire voluntarily from service. Following im appointment, he introduce six points agenda, wey e wan implement, he say dis na to transform di custom service, improve dia work and modernize everything dem dey do; Accurate trade information, broader inter agency relationship, port and logistics processes, border work flow and securoty coordination, among others.

For inside one interview e get wit di Business Year for before im retirement, oga Dikko say di reason im set up di reform agenda na because since di establishment of di custom service, pipo no dey use good eyes look di service. Pipo dey see dem as corrupt, dem no fit stop smuggling and dem no dey committed to national interest but dia agenda wey im inroduce go change all dat.

Custom intelligence unit

Wia dis foto come from, Presidency. However di ex-customs oga get case for court on top accuse of corruption before im death. For November , Nnamdi Dimgba, judge of one federal high court for Abuja, order make di EFCC stop dia case against di former customs comptroller-general afta di non-prosecution agreement between Abubakar Malami, attorney-general of di federation AGF and Dikko.

According to report, Dikko return 1.